This is not from any reader kan kan. Na from myself. I want you guyz to be very sincere with me in answering this question. Me will be sincere with you, so make you too no fall my hand.
The last time I was in school, I washed my boxers in the morning and in the afternoon, I comot am from outside sey make I pack am. Then, I discover sey one boxer wey I just buy, don tear for the under....and na only once I wear am oooo. One of my friends was with me that day. Na hin I sey make I stitch am since it was still very new.
My friend was shocked. He couldn't believe I really wanted to stitch my boxer. He complained, para and said all sort of things....una don sabi me no be today na.....if I wan do something, I would have done it before considering any other person's talk. I finished stitching my pata. I kan face my friend, ask am sey 'so, what was I supposed to do?'. He answered and said 'The boxer is already damaged, you either turn it to a rag or throw it away!'
My head spin when I hear wetin my friend talk. I should turn a new boxer to a rag cuz e just tear for under? Lailai! I never rich reach that side. That one go.
Just yesterday, another boxer tear for under! I don even wear am before I noticed. I changed it but I stitched the torn boxer with needle and thread. Yes! For future use. As I finished stitching it, I remembered my friend's statement that day; 'Na poor man dey stitch underwear'. Na true?
I sabi sey some girls too dey stitch dem pata and bra....that one no really make sense. But, itz ok for a guy to stitch his boxers and singlet sef. If he can't afford to have many boxers. Na wetin me think be that ooo.
WHAT DO YOU THINK? Is it bad for a guy to stitch his underwear?
And wait ooooo!!! Wetin dey tear my boxers for the under sef?.....I already know what you are thinking.....LMAO!
Like my facebook page - The CHNG Blog.
BB Pin - 742EBB2A
Thanks and God bless.
#CHNG - Charming Humble Nice Guy - The Freaky Individual!
...an internet based reality show!
#clearsthroat# na dat one yoruba people dey talk say "ìyen kù die kato" stitch wetin....d money wey u dey use carry girl go canteen dat time nd d money wey u dey give babes now reach u buy 30boxers na....Mr Woman, u no try
ReplyDeleteStop buying made in aba underwear....Annie
ReplyDeletekeep stitching now that you re poor..when you become rich old things shall pass away.
ReplyDeleteTeres Major.