Moku!
Mogbe!!
Modaran!!!
See delegates wey we send go represent us for CONFAB....no be sleep dem dey sleep so? Chai! We don finish for this country.
So, na these old papas and mamas be delegates to the National Conference? Yepa! See as that one (2nd from left - top pic) dey sleep comfortably. Abeg wetin these ones wan go talk for this conference? Jonathan, you are just deceiving us ni ooo. Just continue to maintain status quo, you hear?
My father is a politician, a young vibrant man for that matter. Una no see am send as delegate to CONFAB (make em go bring 12million come for us), na all these baba and mama wey don dey shit for body una send go.
Come to think of it, after the daily meeting, these ones go still retire to their 5 Star hotel room go sleep again ooo. I just hope Femi Falana, Pastor Tunde Bakare and Dora Akunyili no dey sleep like these ones. If dem too dey sleep, then we are doomed!
If I talk now, they will say Charming Humble Nice Guy own too much. Na our grandmas and great-grandpas we send as delegates to National CONFAB, what do we expect?
Hmmmm.....See ME, see BOKO HARAM, na dem mama and papa I dey talk to anyhow so. If you hear sey bomb explode for Ijebu, just know sey na my hand kill me.
Like my facebook page - The CHNG Blog
BB Pin - 742EBB2A
Thanks and God bless.
#BloggingRedefined
...announcing the announcements!
Thursday, March 27, 2014
- 4:52 PM
- The C.H.N.G Blog
- 1 comment
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Ur own don meet u...no be one of d sleeping delegates mud so...chng dey part of people wey use comment kill am...GEJ coming afta u
ReplyDelete