Egbami! I saw hell today. I run comot house this afternoon when dem wahala don too much for me. I called Mercury (a CHNG Entertainment foremost artiste - Download Mercury's latest single HERE). He quickly alerted me of one Iyan (Pounded yam) that was infront of him. He told me to come quckly before I carry the course. I quickly climb bike hoping to meet pounded yam and egusi with big meat.....the idiot served me rice and fish ni sha.....
On my way back home.....Na hin I jam this woman.
God sees my heart, I greeted her. But, maybe she didn't hear or something. I don waka pass her.....she kan call me back and asked in Yoruba language:
"Hen, shey you did not see me ni?"
And if an elderly person don ask you dis kind kweshun for Yorubaland that means, you see am you no greet am. I smiled and told her that I saw her and that I greeted her. I even greeted her again.
Na em Madam gbanaje....sey na lie oooo....I no greet her oooo.....sey no be my first time, not even my second time wey I don dey do that kind thing for her.....sey make I go ask my mama how she take be to our family sey she be my Aunty and I must give her all the respect am giving my mother at home. She was shouting ni oooo. I don't even know her but I dey always see her for some of our family parties.
I felt so embarrassed. I was even blaming myself....sey why I run comot house sef?....me wey be sey na indoor I dey dey always. Na only God save me sey na one corner of our street the stuff happen, and nobody was passing by.....she for just mess me up for some Babcock babes (wey me don dey use style eye) front.
This is common among Yoruba people especially the women. They want to be respected at all cost. I wanted to just walk out on her, buh I couldn't because it would be very rude of me.....so, I just kept smiling and begging her not to be annoyed that I will change....as I was doing that, me dey check around to see if none of those fine and sexy Babcock babes no dey come.....I no wan make one Aunty aje fall my hand. Me wey dem don dey see as big boy and celeb for my area......hehehehehe.
Is there anyone wey don experience this kind thing before? Share am with us, make we use that one catch fun tonite. The witch almost spoilt my mood this evening.
Like my facebook page - The CHNG Blog
BB Pin - 742EBB2A
Thanks and God bless.
Thursday, April 17, 2014
- 7:50 PM
- The C.H.N.G Blog
- 2 comments
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
crazy niccur, na normal stuff b dat one jawe...u never c ones wey go even come report u for ause ontop d issh
ReplyDeleteLolz. All dos pple hen. Na shades and handsfree dey settle dia matter.
ReplyDelete