Wednesday, April 16, 2014

Eyin eyan mi to sure! All of you is gbayi for my side. How market my people? Market for my side dey go small small. Generally, it's been great. We thank God for everything.

So, tonite hen? I want us to trash this out - What really makes the world go round - Love or Money?

If you ask me, my answer is Money. Wait make I explain na. If money no dey, Love no go true. I dey tell you. If you no get money, you go dey tired of this life.....especially in a country like Nigeria.....Haaa!!! Some rich people will oppress you so tey you go wan commit suicide. Your landlord will frustrate you, your neighbors will show you pepper, your friends will mess you up, Federal Government will now make life miserable for you.....Haaaa! Abeg my people, don't dare try to be poor in Nigeria ooooo.....it is a disease.....aswear.

The song wey that my boy Davido sing: "She no wan designers, She no want Ferrari, she say na my love oooo....." Taaarrrhhh!!!! Una think sey Davido dey yarn you true talk? Thatz what we call marketing strategy....he knows for sure that such a lady doesn't exist in this world. Which babe no go want better thing na? When Aiye is not doing such a person. Abi, who wan suffer with love? Nobody na.

As for me ooo, na Money dey make the world go round. If I get better money for hand.....all these babes wey no wan dey look my side go dey rush me like indomie kia kia.......lolz.

The truth is "Love is what actually makes life special...but without money you are in deep trouble"

What is your own answer? Drop a comment.

Like my facebook page - The CHNG Blog
BB Pin - 742EBB2A

Thanks and God bless.

#CHNG - Charming Humble Nice Guy - The Freaky Individual.
...an internet based reality show!

7 comments:

  1. Hmmmmm,true talk,but to me nah love hold d earth oooooo

    ReplyDelete
  2. Love and money! The two goes 2geda, but love is more important sha. *the true yarn be say money runs d world*

    ReplyDelete
  3. who wan suffer with love? Nobody Ooº°˚˚˚°Âºo

    ReplyDelete
  4. Love. Luv can do somethings money cnt. E.g when we love ourselves, tins wil surely turn around.

    ReplyDelete
  5. Na money ooo. Even with dz high level of hatred like in dz b boiz case shey jonathan no still go for olubadan birthday same day nyanya blast occurred?

    ReplyDelete

C'mooon, don't just leave. U gotta say something ;)

CHNG Entertainment. Powered by Blogger.

PROMOTE YOUR MUSIC WITH US!!!

MAKE COOL CASH ON WWW.442MANAGER.COM | CLICK IMAGE TO SEE HOW!

BUY 'THE PREGNANT CORPER' @N200 ONLY HERE

Popular Posts

Blog Archive